MAMA, I HAIL #Mamareadandbebless If I talk say that day I no - TopicsExpress



          

MAMA, I HAIL #Mamareadandbebless If I talk say that day I no shock Na lie I dey lie. That day wen you wake up 5.00am And you say O o o, I wake up late today? Infact, the shock reach my bones Because na 4.00am be your waking time Every blessed day without alarm. At age 84, your body strong kakaraka No be God? As you wake, after you don pray for everybody. Na so you go bounce go kitchen Arrange those your beta beta food Wey no dey lack any nutrient. Wey dey belle-full person and the aroma na die. For this your ripe age People still give you contract To cook correct Ogwo soup for party And dem no dey like make the food quick finish So, dem go pack go keep for their fridge. Na for your house Every pikin wan spend holiday Because na you Be both papa and mama to everybody. And as you dey get, na so you dey give out. Mama, I like you well well for one thing But no be only dat thing o o o And the thing be say Even if small pikin correct you You no go mind, you go accept. Your heart big pass River Niger. Na him make you Dey quick dey forgive Anybody weh vex you. Mama, you too much. We dey pray for you Make Baba God continue To give you long life and beta health So that all of us Go continue to suck your breasts Weh no dey dry. #MyFirstPidginPoem #MamaLagos-NoShaking
Posted on: Sat, 29 Mar 2014 20:22:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015