SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 15/10/2014. Hon. Henry Ofa - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 15/10/2014. Hon. Henry Ofa Show Us Ur Report Card. AS THE COMMISSIONER FOR DESOPADEC. Na from creeping nai pikin dey waka. The thing wey our Government dey find dem go soon see am. E don dey obvious to me now say most of Sapele Okpe leaders nor get brain,make unu sorry if dis insult too harsh,but e good make truth dey come out. I sidon dey imagine say Sapele people nor get this small medium to address issues,how e for be? Becos things just dey spoil dey go and nobody cares to talk put becos Sapele Town itself dey form big boy,base on say the Town dey rub shoulders with places like Lagos then,so the thing cum affect the people wey get the land for deir coconut,dem nor come know when to act and wen not to act,all na base on say dem dey even dey beef eachother,as family dey ontop for Sapele,apart from the Dafinones wey just get one kind fame. This media don talk am before say DESOPADEC for Sapele nor get effect and na thieves,nai dey handle dis offices. Since when Hon. Henry Ofa enter office to represent three Constituencies wey be Ethiope West,Sapele and Okpe Local Governments,make unu tell us for Sapele,wetin dis man don do for Sapele wey get head? See Ajimele Road,Water Street,Orhorho Rd,etc wey e don commence since,e don finish dem? NO. Go Oghara and Okpe Desopadec Projects dey reach completion,but why Sapele own dey different? Na from here i dey complain say this Okoloko Bridge wey unu helep us renovate,nor good? Na everyday i dey shout put,dey phone you Hon. Henry Ofa,u go dey tell me say na the best Engineer nai handle the project. Wetin dey worry you sef? How you go build Bridge,Bridge nor go get Vents? Oyibo wey do the brige access am well,cum put Iron Rays as demacation,dem be fool? You carry ur stupid contractor come build fence ontop Bridge,to add more weight to the Bridge. With the weight of that Slab wey first dey crack the Bridge now from under,u come leave us with flooded Bridge. Hon. Henry Ofa,if i swear give you,if one Single Sapele Soul die for that bridge,na ur full generation nai e go affect. I go first carry Egweya to go naked swear for you,as the female land owners,den i go pull all my Regalia dance naked for Olympia use Bible take stone Oghara. Because report don enter my ear,say dis tin don dey wan go on side. You dey do better projects for other Local Governments,but when e reach Sapele own,u say na Death Trap nai you wan do. Dis morning i kneel down for Okurighwre Roundabout they beg you with my white Caftan wey i use sleep,take dey order you,now to go break that fence commot from the Bridge and make u put the one wey you meet there before. No excuse for this one. If this man nor do this thing nai be say i go real smile,becos na we all dey pass the bridge and i believe say,na when unu Convoy dey enter Sapele nai the Bridge go Collapse. Sapele get Chairman Kogho,wey be the Chairman of Desopadec wey dey stay Miller Estate here and e just lock up,like say e nor dey see the Amukpe Road since. Who unu dey do now? Unu nor see say the wickedness don really waka enter unu vains,becos unu dey feel say na only we poor dey pass there? Atink before unu go leave Sapele go board Plane,unu nor dey pass the Amukpe and the Bridge? I know say,as unu don see dis big floop from unu own person for this Okoloko bridge,unu go rush go repair the Amukpe. No! Make unu leave am,like that,we the poor people like am like that atleast na both Jeep and Small Keke nai dey spoil dere now. Hon. Henry Ofa na so you make mouth through this forum,say u wan buy Buses to ease our Transportations for Sapele,you still promise Transformer,wey u nor bold buy at the end of the day. You even cum promise our Market people,say you go Instal Street Lights.etc You see how stupid you are? I begin to woner the kind of Schools unu go becos na empty brain most of unu dey carry waka. Upon all the many promises wey u nor fit meet up to,na Okoloko Bridge wey u go use Common sense take package nai just bring ur legs come out. Delta State Government unu see say unu dey disgrace us the masses,before the Nation? Unu go dey appoint people into offices,wey dem nor merit,but due to constant Loyalty,unu go dey give them offices. Unu nor dey see Lagos State,Edo State and others? Unu dey steal money,we norva complain finish,the small projects wey unu go still manage do,unu go do am with inferior materials,and with uneducated sense. All unu wey be Office holders,Hon. Henry Ofa just disgrace unu for dis Okoloko Bridge,becos na now e finally helep us comfirm,say na the best things nai we dey talk from here,and if only unu fit dey borrow sense,and make unu drop unu Pride,unu go see say we go dey progress. Now na the money wey we for use do another meaningful project,nai unu go still use take go repair this Bridge again. No wahala,make unu try do am fast becos Sapele get only 2 entrance and e nor go funny if bad thing happen to this Okoloko Bridge. Hon. Henry Ofa Sapele people nor go fit take dis flood for our bridge,find solution now. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. Anoda Oghara man again abi? Sleep dey catch me,my head dey hot. Henry Ofa show Us ur Report Card. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 15 Oct 2014 06:12:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015