THE CONVERSATION. (on a Sunday evening ) Ikenna: Baba whats - TopicsExpress



          

THE CONVERSATION. (on a Sunday evening ) Ikenna: Baba whats up na? Bayo: chieftus I dey oh, how your package? Ikenna: guy you no well oh, why you leave me for church go house na which kian thing be that? Bayo: Haa! I check you na, no be you go dey that elders side, I no know whether you wan join church committee.. Abi you go fill form.. Ikenna: see this big head oh.. Why you no signal me? Or even flash me say you Don dey go? Na my pops call me make Im tell me stuff wey I go go do for house oh Na Im Elder Thompson come call me.. Bayo: Hehehehe, Shebi Im ask you Wetin you dey always do around Im pikin? *tongue out* Ikenna: Hahahahaha, Nawa for you, how many times you Don see me and gift dey talk? Omo the man Sha dey interrogate me unto grad package Na, say Wetin I dey do now, set Wetin I wan do with my life, Sey where I wan work?. Bayo: you no tell am say boys dey roast, make Im find us work for Im office? Ikenna: I play am the tape na, Im come dey talk plenty, the man drop some truths Sha but me I never see solution, at least me I been dey think say as im dey ask me like that na either say im gimme something to do or connect me. But me no get anything oh.. Ikenna: but e get Wetin im talk Sha, I say I go play you the tape.. Bayo: Wetin be that, Oboy hope say Na better.. Ikenna: Im tell me say, Im driver wey dey drive Im kids don take leave for two weeks for im papa burial, so Im talk say make I help am find person to fill in for two weeks.. Bayo: Mtchew.. This boy self SMH.. Ikenna: wait na, I reason the thing na, Omo, I come tell am say I sabi drive na, Im come dey ask me whether I go fit run am unto say I be graduate and all.. Bayo: the man self know, you wan turn driver, Mumu boy. Ikenna: Wetin dey do you? You no go wait make I play you tape finish,? Bayo: continue. I Jus dey look you.. Ikenna : i tell am say I fit, then im say make I go collect permission from my pops, I tell am say that one no be p. Im say in that case make I find someone wey me and Im go dey follow, as be say Their school far, and we dey commot very early in the morning, then I fit dey with the car until time to pick them Don reach, then in the evening I can park the car. Bayo: Hehehehehe.. Choi.. Naija don kie person.. Ikenna : why you dey laugh? The man say, he will give us (if youre interested oh) 35k at the end of the Waka.. And anything wey come up make I let am know.. So my guy are u game? Cos me, my mind is set.. Bayo: how two graduates go siddon inside car dey drive kids about? Nawa oh ik reason am na.. How you go dey do this type of thing... Ikenna: bayo make I ask you, when be that chevron exam wey we one go? Bayo: next month.. Ikenna : you know of any other interview or exam before that one? Bayo : nope.. Why? Ikenna : Na im be say we de siddon for house for the next one month Abi? Bayo: Ehe? That one no better for me? Than to turn driver.. Abi na bus sorry car boy, since na you dey drive.. If person see us nko.. Nawa you oh.. Ikenna: this boy.. You dey reason low whalahi.. Make I ask you.. Since February wey we commot for service, you Don Waka for Lagos pick 15k for ground? Now a stressless oppurtunity has come to make 15 k.. Has come.. You dey form graduate.. Dey dre, hunger go wound you.. Bayo: emmm, Wetin be your point now? This thing wey you talk make sense.. Ikenna: no be you dey ask your bros for money for subscription the other day.. Till now im never give you, you no know as God dey work.. You dey look your swag, inside money wey you no get oh, I dey see oppurtunities.. Ikenna : I dey see this thing as chance to dey a Lil closer to that man, you know say Na im be MD, what if God decides to bless us from here and this is the ladder to climb.. You wan dey inside house dey form graduate.. Na Prado jeep we dey drive oh no be say Na kabu kabu.. This boy.. E be me like make I flog you right now.. Bayo : Hahahahaha.. Chai ik my man! No vex I no see am like that, I dey tell you.. But you make sense oh.. Ikenna : dey dre dey carry Im a graduate dey parade.. This is 15k in two weeks.. Some of your graduate friends earn that in a month.. Ask around.. Do you know the number of important people we might meet, as we go dey front the man house morning and evening.. Even if not.. Guy 20k in my pocket is sweet something.. Bayo: Kai.. My brother Im game men.. I no see am like that.. But why you no share the money equal Na.. Why do I get 15k?.. Ikenna : Na so the man talk am, Oboy no dulling oh. Youre a man,bible talk say seest thou a man diligent in his work. He shall sit amongst kings, boy.. Way na way.. As far as its positive.. And it doesnt bring shame to your family nor God.. A man should hustle.. Bayo: pastor ik.. Shebi I tell you make you go answer God call, you dey give am call waiting.. No worry.. E go clear your eye one day.. Hehehe.. Thanks brother.. You really opened my eye to something.. Where I go block you for tomorrow Waka? .. Ikenna: guy before we begin chop that 250k salary wey dey front wey we no even sure of oh.. Make we collect this one put for pocket.. About the meet up.. We go yarn later, pops dey call me abeg, later mehn.. Bayo: Thanks mehn.. No p.. N:B -The characters or infos in this story are not real.. Just put together to drive In a much much better way.
Posted on: Sat, 15 Nov 2014 07:24:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015