TRAGIC!!! Oyibo go say Terrible Eye Sore.. (Killing of Delsu - TopicsExpress



          

TRAGIC!!! Oyibo go say Terrible Eye Sore.. (Killing of Delsu Student) ..Make we all wake up one morning come find out say all dis things wey dey happen for Naija na just a Dream. The News of ALUU 4 still dey ring bell for our ear na so anoda one of Delta State student Ify Gabriel Nwainokor don bring water comot for our eyes.. Ih happen on Sunday, July 21st dis year, as de news take be Ify and ihn friend Kazeem dey waka for street for Lagos (Ajara Badagry) wey no far from ihn crib na so people hold dem come talk say dem be Ole. For inside de 8min video wey dem record na so people dey shout kill dem kill dem, anoda pesin comot sharp object wan chop off on dem prick. Ify Nwainokpor dey beg dey beg say make dem no kill dem say dem no be thief, all dem cry cry no enta dem hear na so dey massacre dem shapally. Ihn father, Samuel, follow news-men yan, ihm yan say dem nab ihn pikin and ihn friend as ihn dey waka for street na so people some people hold dem say dem be thief Ihn yan say Nwainokpor, na final year student of Geology and Mining ihn dey wait make stike finish so ihm go go school back. “I look for temporary job for am,since dem lecturers neva gri resume. ihn dey go work everyday except for Sunday. The day wey ih happen I dey Ghana na so I receive call say dem don kill my pikin and my wife de Delta state dey take care of my Mama. Na because dem rob Agara four days ago na so dem fink say na thief my son be. Ihn yan say de youth call de head of de vigilante group for de area ihn name na Asiribo, ihm come de place wit gun na so ihn handcuff my pikin and ihn friend before ihn begin to dey ask dem questions, ihm come decide say make dem carry dem go de Baale, Agano Oniyon of Agamade Ajara. As dem dey go, Asiribo dey try put ihm gun for d gun pocket na so ihm mistakenly press de trigger d thin shot ihm own belle na so ihn die straight up. Everybodi come vex begin dey para say na dem don cause de death of Asiribo, d people no hear any oda thing na so dem carry sticks begin dey beat dem, and police dey dere ooº°˚˚°ºoo As de Popsi dey hold ihn tears, ihn yan say ihn don dey live for Badagry since 1982. I get only two pikin and Ifechukwude na de first. Ih come dey sad say na de same area were dem born na ihm dem kill am. I don dey live here tey tey, de people go bear me witness say my pikin dem be beta pikins, dem no dey look for trouble sam sam. Nwainokpor’s Oga for work, Aloysius Onyenibedi, follow news men yan, ihm describe am as honest and hardworking pesin. “I trust am to de extent say I fit keep big money wit am. Ihn dey very very good to my children and everybodi. Na wa ooº°˚˚°ºoo .. All dese kyn fin make we just wake up come find out say na dream dem be.
Posted on: Fri, 02 Aug 2013 09:45:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015