This morning I just dey escort one of my friends to the bus - TopicsExpress



          

This morning I just dey escort one of my friends to the bus stop from my house when I see one clean beautiful girl come out from her Brand New Range Rover SUV dey cry, dey kneel down dey beg one slim bobo wey be like say him never chop for months.The babe just dey beg dey cry dey follow the guy, dey tell am say she no need money, she no need Brazilian wigs, she no want house or anything, she say she no even need the SUV all she want na him love, him kisses and him warm embrace. The babe just dey shout dey cry.When I hear these words my heart stop, my head spark and my brain burst,the guy no even dey look the babe sef, na there me come vex say if this guy no value this girl well right now me I don fall in love be that, so make I go claim this girl. But as I near them, one man just touch me for back say Mr Man abeg no block the camera… na film dem dey shoot....
Posted on: Mon, 03 Nov 2014 17:46:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015