To sit down beside driver when u dey travel na wahala o, all the - TopicsExpress



          

To sit down beside driver when u dey travel na wahala o, all the thing wey don dey their mind since, na ur head dem go pour everytin put, dem no wan even know whether u no dey interested. Even if u put earphone for ear, dem go still dey tell u their story. If u sleep sef dem fit wake u continue their story. U go come dey pray make una quick reach where una dey go. At least, when he go happen to u, u go remember say i don warn u b4.
Posted on: Wed, 04 Sep 2013 16:10:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015