U celebrate birthday for nightclub u dey do opening prayer - Na - TopicsExpress



          

U celebrate birthday for nightclub u dey do opening prayer - Na God go slap ur mouth. U come back from dubai dey form British accent. -Na rat go chop ur mouth U be house boy u come dey playick Ross - I am the Boss-4 where u Wan make dem sack u na.....mumu dey Wori U U dey add water to egg say e go plenty when u fry am. - Why u no add yeast join am...olodo. U no go university, and u dey find ur name for NYSC posting. - Na yeye dey worri u. House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....udon die. U de say Terry Gs music dey inspire u - unto which level!unto madness Tinz abi U carry candle dey look for where fuel dey smell for nyt . -continue u go soon see am Wen ur color don change U call MTN to tell dem sey ur free browsing has stopped working. - Lolzzzzzzzzz.....mad man When pastor talk say Do something crazy for the Lord u come carry church offering run - na who wan chase u? U read dis & u no comment wen u smile finish u B olodo U no dey appreciate
Posted on: Sun, 10 Nov 2013 22:27:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015