Night Of A Thousand Laughs - NTL U celebrate birthday for - TopicsExpress



          

Night Of A Thousand Laughs - NTL U celebrate birthday for nightclub dey do opening prayer- Na God go slap ur mouth. U come back from dubai dey form British accent.- Na rat go chop ur mouth. U be house boy u come dey play Rick Ross Music - I am the Boss, 4 where na.....mumu U dey add water to egg say e go plenty when u fry am, Why u no add yeast join am....olodo. U no go university, and u dey find ur name for NYSC posting, Na yeye dey worri u. House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher- Hahahahaha....u don die. U de say Terry Gs music dey inspire u- unto which level!! madness abi? U carry candle dey look for where fuel dey smell from...continue u go soon see am. U call MTN to tell dem sey ur free browsing has stopped working.- Lolzzzzzzzzz... Mad man When pastor talk say Do something crazy for the Lord, U come carry church offering run- na who wan chase u?.....U read dis & u no share am wen u smile finish- na only u de Stingy 2 d last...Share make evrybody laff Joor..
Posted on: Fri, 18 Oct 2013 07:14:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015