"U used BlackBerry to oppress, now everybody has a Black - TopicsExpress



          

"U used BlackBerry to oppress, now everybody has a Black Berry.*You used ur camry to Buga, now boys use Camry to do taxi.*Before u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka. *B4 u dey use ur ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry comot house. *B4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary skul student don dey wear am troway. Before u dey go vacation for UK dey talk pass urself, boys don dey buy first class ticket dey enta london just to golick ice cream.. BOTTOM LINE No dey over do like say dat tin no go reach another person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean... No forget say tortoise-car na big man motor before o... Nothing wey come wey no get expiry date, even the life u have na borrow you borrow am... Humility na the best choice.
Posted on: Thu, 29 Aug 2013 17:42:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015