U dey carry ur girlfriend go club, after u marry her finish u wan - TopicsExpress



          

U dey carry ur girlfriend go club, after u marry her finish u wan to stop her frm goin to club. My broda u think say miracle fit happen? • Ur gafrnd dumps u for a rich man, u say she b gold digger, bt ur sister do d same to anoda guy, u giv testimony for Church saying na grace of God. Bros park well • Your babe get F9 parallel for WAEC, she still dey ask for Brazilian Hair of # 150.000 .Abeg Were she wan fix am?, ontop that coconut head? • U have 8 tribal marks, stretch marks scattered all ova ur body yet u still want a tattoo...ah! my friend u be zebra? • U are 6ft tall, u still com wear 6inch high heeled shoe...shey u wan whisper to God ni? • U dey snap inside different type of cars yet u expect ur man to believe u are not cheating. .aunty, u be mechanic? • U gather different gals picture for ur fone & yet u xpect ur gal to believe u are not cheatin.. uncle, u be photographer? • He gave u an engagement ring for over five years, he never go pay ur brides price u, my dear u be lord of d rings? •you dey pay your babe wey dey university school fees and yet u never write JAMB,u be scholarship board? •U are 18yrs and ur sugar daddy is 70yrs old and u stil dey call am BABY, my sister he should be ur ANCESTOR. •Your babe is licking ice cream...ure drinking pure water...Bro Are u diabetic? •U claim say u eat rice and stew, but u vomit fufu and egwusi soup. Omo u be magician?..lolzzz
Posted on: Thu, 27 Nov 2014 07:46:45 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015