SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. My people peg dey useless - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. My people peg dey useless without Cloth and rope. Proverb 4:1. Listen to wetin ur Papa dey teach u,my Son. Pay attention make u for get understanding. I don talk to all d big names wey get Government office for Sapele,Delta State and Nigeria and some of dem dey hear my word well well. I announce from here say Oga Moses Ogodo tell me for Phone say e wan use Seplat money wen dey come the Community take buy Transformer and e mention say e go drop one for Sapele General Hospital,as dem dey complain badaly say dem nor dey get beta light take dey work deir work becos say deir Transformers dey bad. My people na God wen dey up nai know wetin happen to stupid Moses Ogodo,as e fail to understand d office wen e dey occupy and as e be illitrate,e nor even know d value of Sapele General Hospital for our body. D mumu go dere (General Hospital) go dey gap mouth say e go buy the Transformer give dem. Na history book d mumu promise for end,as e nor go back again and e nor buy the Transformers again. As we dey talk so,we cum dey map strategy how light go use take dey permanent for our General Hospital. Hon. Henry Offa talk to me yesterday and e tell us say e don go instal New 500KVA Transformer for our General Hospital,as light for dere don improve well well. So we cum discuss plenty tins wen Sapele dey lack. Na for dere Hon. Henry Offa cum tell us say e don reach our General Hospital and e nor like as d place dey at all. So e don promise say Desopadec go touch d Emergency Ward,dem go buy Oxygens and oda better equipments to upgrade the public Hospital. Also we discuss and e agree to embark on the Street Light for Market Rd, immediately the new budget money reach e office. The issue of Transformers,i tell am,make e use d Money for Road repair,becos the New Company go try to improve deir facilities wen dem fully take over soon. From our Studio we don finally draw the attention of the Desopadec office to look into; * Adeniyi Road. * Ireto Road. * Ojolu Road. * Ajimele Road. Dis 4 Roads go witness construction soon,as we don beg Hon. Henry Offa and e tell us say he go put am for 2014 Budget,so we wen dey stay that portion and area make we get hope say our Roads go correct soon. Also if unu know of any project wen Desopadec dey do and dem nor wan complete am,make unu try call dis 08056702739 as na deir complain lines and the Honourable wen dey incharge go enter wahala if e think say e go run leave any community work. Mainwhile make i let unu know say General Hospital go dey equipped well soon and Market Road go experience Street Lighten soon. Also some Rural Roads and Schools go receive touch from Desopadec. I want make unu drop any complain wen unu get against Desopadec,so that Oga Henry Offa go attend to am quick,so dat we nor go report am go for the centre complain office. Oya. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 05 Nov 2013 13:23:37 +0000

Trending Topics



class="sttext" style="margin-left:0px; min-height:30px;"> Old Bootnecks never die. I met him at the Staffordshire Wall,
A LIVING HOPE BLESSED B (GOD)----WHO ACCORDING TO HIS ABUNDANT
Wear your grudge like a crown. Desperate to control. Unable to

Recently Viewed Topics




© 2015