SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 06/07/2014. Sometimes when - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 06/07/2014. Sometimes when we dey reason about woman, some pipo go talk say where you meet woman matters well well. Some go say if na club you meet her, she fit nor get good attitude. And if na church, she fit get good attitude. Nai make many women, when dem don groove groove groove sotay their meter don dey weak, dem go dodge come church come dey form holy Mary. All na to catch men wey dey feel say na church dey get the best women as wife. We dey Peter dem house for Effurun. I follow am go meet e papa and mama when e carry the babe wey e wan marry go meet dem. Na when we for dey eat owo and starch wey e mama prepare with us nai e senior brother enter parlour. The eye wey e take jam Peter babe, Doris, for dining table nai be Wetin you dey do here? E talk the word like say e know Doris befor. When Doris look am well, she come bow her head in shame. Na there. Peter elder brother for talk say e know Doris for Club 0305 four years ago. Me and Peter come dey hold ground say e nor mean and now, she nor dey work as dancer for the club again. Peter mama and Papa with e senior brother nor gree make Peter marry Doris again o. Na when the quarrel don too much nai Peter fling e babe nai we all drive come back to Sapele. My pipo, make we dey mind wetin we dey do for this life becos anything we do today, get feed back tomorrow. From my own assessment, I nor dey judge person from e past becos change dey constant. Anybody fit change anytime. But the issue be say, all humans nor dey reason the same way. When some thing nor good, make we try nor doam. We know say once a soldier is always a soldier. Now, the issue wey dey ground be this, Wetin you advise Peter to do since na marriage issue be this and we all know say, if you marry, you don marry. A. Call of the Marriage. B. Go ahead and Marry Doris even if he family nor support am. C. Extend the marriage to make sure say e study Doris wella to know if she don really change or not. Make I go buy engine oil take cook beans chop as I dey wait unu answers. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 06 Jul 2014 15:27:17 +0000

Trending Topics



v>
I wasnt going to post about my mystery FINDING SKYs award
Dear rap addicts Those who violates the obvious rules of this

Recently Viewed Topics




© 2015